Powered By Blogger

Saturday, 6 June 2015

Only in my country

Image result for nigeria

ILOVE NAIJA I NO GO LIE!!!
God Bless Nigeria!!! Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading N200 MTN Recharge Card.
Na only for Nigeria you go see fish inside"MEATPIE"
Na only for Nigeria we dey count money after we withdraw am from ATM because we no even trust ATM machines.
Na only for Nigeria PHCN dey sey:-
Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill (wat a pity)
Na only for Naija people dey horn for traffic light make e quick change from Red to Green.
Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card, Chin chin,
Puff puff and beer.
Wetin you no see for Naija, you no fit see am anywhere in d world...
Trust me.
Na only 4 naija you go find a graduate of Mechanical
Engineering dey do him NYSC 4 Police station.
na only 4 naija you go see one person dey use Bold5, X3, Ipad and Nokia N8 all at once.You be Bill Gates? Abi na you invent internet
Na only 4 naija you go see a graduate of law dey work as generator repairer.
Na only for Naija u go buy coke, dem go say make u no forget to return d bottle.
Na 4 only Naija, you go see
madman dey control traffic,
people wey their head correct dey
obey...
Na 4 only Naija, you go see advert from native doctor on how to make quick money.
Na only for Naija u go wish somebody 'happy birthday', he go answer 'same to u'.
Na 4 Naija obituary poster dem go say "MAMA HAS RELOCATED"
.. im proud of dis my country we dey unik

No comments:

Post a Comment